Psalm 23 Nigerian version
Fenny West        2nd page of writings
/l/images/26498726.jpg

 

 

Oga kpata kpata, na my Shepherd

A nogo carry bowl de beg about.

 

Im make me lie down for pasture wey green

There im make my soul kampke.

Im de lead me for the road wey dey right

Because of im name.

 

Ah, even if I walk through

gutter wey pass power

A nogo fear any evil.

Because you dey with me,

you no dey commot for my side

the cane  and stick

wey you de take keep me in line

make me get common sense

and give me comfort.

 

You prepare some kin table for me

wey my eye never ever see

full of pounded yam, okporoko

jollof rice, egusi soup, moi moi,

elubo, efo, akara, onunu, ogbono

 

dem too boku, my mouth

no go fit mention all of  dem.

And all this you de do

right in front of my enemies.

 

You pour oil for my head

I come run all over me

Make my cup dey overflow

 

A no sey goodness and mercy

Go dey follow me anywhere  a go.

And a go rest for your house lai, lai. Amen.

 

FennyWest

/l/images/63316709.jpg